As we declare war,
We come make rule say;
We go only sink war ship,
We go only shoot down war plane,
We go only bomb barrack.
We come make rule say;
We go only kill soldier.
We come dey sink war ship,
We come dey shoot down war plane,
We come dey bomb barrack,
We come dey kill soldier.
Di war ship we sink carry soldier,
Di war plane we shoot down carry soldier,
Di barrack we bomb soldier live inside,
Soldier Sef Na human being.
Na papa and mama born soldier,
Soldier get get people wey im love,
Soldier get people wey love am,
Soldier get blood for body,
Soldier Sef na human being.